Monday 20 May 2013

ARSENAL DE MAKE NOISE Chai, see me see wahala o! But weting make Arsene Wenger de hate Chelsea like dis? Abi na Chelsea make'am he no de win trophies for almost eight years now? Dis time around Arsene Wenger de blame UEFA say Chelsea we be failure for Champions League no suppose come play again for Europa League talkless of winning it. Dis French man de yarn say e dey vex'am well well as UEFA come helep Chelsea win de Europa Cup on top of Champions League we dem win last season. Wenger come yarn say Chelsea and Benfica we been comot from de group stage of de UEFA Champions League no suppose come drag'am again with de clubs we start'am from de beginning. Dis man still come tok say dem ma (Arsenal and others clubs) we worked hard and comot from de round of sixteen no fit play Europa and dat dis thing e no gud and e de pain'am well well for belle. He neva tok finish o, Wenger come say im ma for like win Europa too but help we UEFA de helep dem London neighbours so e no fair at all at all. He come salute dem London rivals we be Chelsea for de Europa trophy we dem carry. But he still de tok say he no dey happy as Chelsea come be Champions for both Champions League and Europa League at de same time. Abeg how una want take react to weting Arsenal manager de yarn so? I de salute una! Kingsley Bassey. Up Chelsea!

No comments:

Post a Comment